Fenerbahce sack Jose Mourinho afta e fail to qualify for Champions League – Ghanamma.com. Fenerbahce don show Jose Mourinho di exit door afta e fail to qualify di club for di group stages of di Uefa Champions League.
Di Turkish club bin lose 1-0 on aggregate for di Champions League playoff matches wey dem conclude on Wednesday.
Dis Friday morning, Fernabache post dis message on top dia X handle: “Our First Team technical director, Jose Mourinho, who bin dey carry out im duties since from di 2024-2025 season, don part ways wit us. We thank am for im efforts for our team until today and wish am success for im future career.”
Mourinho don manage 10 football clubs for im coaching career including Real Madrid, Chelsea, Manchester United and Tottenham.
E bin lead Fenerbahce to second position for di Turkish league last season, but im tenure get plenty of controversy.
Galatasaray wey be last season champions for di league bin say dem go “initiate criminal proceedings” against Mourinho, afta dem accuse am say e bin make “racist statements” following dia 0-0 draw for February.
Mourinho deny di allegations and say im na di “opposite” of racist, and e later file court case against di club say make dem pay am damages of about £41,000.
Di Portuguese manager also dey always criticise di standard of officiating for Turkey, and for one occassion dem bin give am four-match ban – later reduce am to two matches – for im comments about referees afta di match against Galatasaray.
Mourinho join Fernabache in May 2024 afta e sign two years contract wit dem, but tori for Turkey be say di 62-year old bin dey get wahala wit di club board sake of dia strategy for di ongoing summer transfer window.
Afta Benfica knock Fernabache comot from di Champions League, Mourinho tok say
Speculations don already dey fly around about wia Mourinho go go next.
For October last year, afta one Europa League match against Manchester United wey end 1-1 and wia Mourinho chop red card, e tell tori pipo say afta im contract wit Fernabache expire, im go like to go to any English club wey no dey play European competition.
“If any club for England from di bottom of di table need a coach in two years time, I dey ready to go,” Mourinho tok.
Who be Jose Mourinho
Mourinho no too achieve much as a professional footballer and e no even play for long time, e retire as a player at di age of 24 but na as a coach e make im mark wella.
E start im coaching career as interpreter for Sporting CP and FC Porto bifor e move to Barcelona as assistant coach.
In 2002, e return to FC Porto wia e carry dem win two league titles, one Uefa Cup and one Uefa Champions League title. Di UCL victory na wetin really bring Mourinho into limelight for di football world.
E den join Chelsea for di English Premier league, and for im first season e lead dem to win dia first EPL title in 50 years, wit a total of 95 points, wey be a record for dat time.
During im press conference as e dey join Chelsea, Mourinho bin make the popular comment wia e refer to imsef as “di Special One”.
In total, Mourinho win two Premier League titles, one FA Cup, and two League Cups for di three seasons wey e stay as Chelsea coach.
For Inter Milan, di Portuguese tactician win di Serie A title for di 2008/2009 season wey be im first year wit di club. For di second season, e win three trophies – Serie A, Coppa Italia and UEFA Champions League. Dis na first in history for any club for Italy.
Mourinho also win di Spanish La Liga wit Real Madrid for di 2011/2012 season, bifor e return to Chelsea in 2013, den Manchester United in 2016, Tottenham Hotspur in 2019, and AS Roma of Italy in 2021.
E lift di Europa League and League cup wit Man Utd, reach League Cup final wit Tottenham, win di first edition of di Uefa Conference League wit Roma in 2022 and also lead dem reach Europa League final di next season wia dem lose to Benfica 4-2 on penalties afta regular time bin end 1-1.
Mourinho dey considered by many sabi pipo as one of di greatest football coaches for football history.
Asides from coaching, e dey work sometimes as footbal pundit for TV.